Name:
Location: Somewhere only we know, Distant Land

Me's a whole lot of things that even I find amusing... I'm definitely a romantic and I advocate honesty at all costs

Thursday, June 14, 2007

Tinu ...hmmm!

Hello amigo! Guys i havent written much in a while. My apologies, its not because i'm bereft of gist (trust me na!) Its just a weird combination of baby-sitting and oyinbo gbeborun! Omo, i think say na only naija people dey gbefila and gbegele but au contraire, these people invented the remix.
How person go siddon for their room dey yarn and all the people wey dey their flat go don hear all the things wey them yarn. Omo i bow unto dem o! As if that wasnt enough, my cousin has been toasting me to baby sit for her two kids for the last month. She's been using every trick in the book and well I let myself fall for one. Honestly i have no problem babysitting, infact i think babies are cute when they arent yours. so when you spend an hour or two with them and they get on your nerves you can leave...so asking me to spend a whole week with a bunch of 2 and 3 year olds is really pushing it.
The main reason why i dont want to go is my cousin's mom. She's my mom's elder sister who thinks the best way to encourage me is to keep bugging me about man, marriage and how soon?. She cant actually have a simple conversation with me without mentioning something to do with marriage. She no even dey ask boyfriend na fiance she dey ask. Na wa o! I wonder which vessel she'll pop if i unleash my milky darling....LOL.
The one wey annoy me pass happened when i went over the last time, She go wedding on the saturday before i came and gathered all the wedding favours and came to give me.
'Thank you ma' i replied politely and collected them. I con go kitchen go dish food na im she come meet me dey yarn say make i no worry o, say my little cousins go do little bridesmaid for me...HABA??? Omo, as i left the house, i sharply called my mom ( who by the way is the most awesome person in the world) She told me she'd speak to her and i trust my mama, ' e ma fiaye su omo mi,' '(dont stress my daughter) Yippie! wonder mom to the rescue. when it comes to these old people, person no go fit yarn their mind before them go go villa go dey report person to everybody in the family. hmmmmmmmmm....another day in the life of naija chick.

On another level, i be wan yarn you the gbeborun things but my spirit be tell me say, dem gbefila themselves fit go assidentalli jam the info here so man pickin must maintain. Eyin peeps i dey. I bin dey read say Temmy no dey update blog again now that romeo don return to naija..hmmm aunty wetin una dey do wey u no fit tell us, your paddies for blogsville eh? And NB Baba don take permanent abode for facebook, im no dey com crack im 50kobo jokes again....LOL.Its all love bro! I hear say 'dem ladies there no wan leave you...hmm, the boy is a champion!!! LOL.
I really have missed you guys. Infact we dey go barbecue tonight gan sef (for here, na night we dey do barbecue) if you all the kin orisirisi i don chop eh? unna go fear for me. Mr man do me surprise show up last week. Omo, na the sky level i still dey o! That man bin get something. That man bin get some kin juju.... I mean u sef check am. Two week trip turned to two and half, i don dey vex, dey provoke! dey yarn say this time sef, i no know, haba? how person go get bobo who's house dey 20 mins away but na long-distance relationship person dey practice. which kin palavar i go put myself? Trust me na...i don prepare speech...'its not working, i cant handle it...bla bla bla' OMO by the time the broda show face...hmmmmm!
Teva still dey hmmmmmmmmm!!!


Have a fab week y'all!

7 Comments:

Blogger Delilah 3 said...

Your heart just kuuuleee just melt like ice cream under the Texan sun abi? i know the feeling. lol. so what did he bring back from Singapore? i fit get something? dont forget ur paddy o. lol
the wedding should be in dec or jan but am gonna let you know when i have the details. would love to see your face.i guess it is beautiful.

6:20 PM  
Blogger Teva said...

Awww, thanks dear and i'm so happy for u. just make sure its not around christmas time o cuz u know say as per naija concerns- man pickin gats to go home...LOL
All goodies are for me girl! LOL, not hing for u!! LOL..

6:26 PM  
Blogger Ubong Da said...

As una dey yarn wedding matter make una no forget invite me o! Make i come check out all those your lovely, young succulent cousins abi sisters.

teva wetin lover boy bring for me

2:05 PM  
Blogger Teva said...

Ubong...bros, cool down, im sure you have ur wives already...leave my cousins alone...LOL. Thanks for dropping by. BTW, everytin he brought for 'feminine'if you know what i mean.....LOL

2:27 PM  
Blogger temmy tayo said...

Haba,madam Teva who tell u say i no dey update again. Na the tides of life o. Lol

No mind ya aunty, just tell her that God's time is the best.

7:10 PM  
Blogger IJEOMA said...

lol. thats funny.. children are cute when they dont belong to you..

6:34 AM  
Blogger NaijaBloke said...

So na me u cum dey yab for here say I dan buy land for facebook abi?No be ppl like u force,coherce,trick,seduce etc ..LOL to join.

Anyway how u dey,I can see say u dey aiight sha, awon brosses nko,hope u r allowing them to breath sha ..LOL

Take care

4:36 PM  

Post a Comment

<< Home