Name:
Location: Somewhere only we know, Distant Land

Me's a whole lot of things that even I find amusing... I'm definitely a romantic and I advocate honesty at all costs

Saturday, February 03, 2007

hmmmm....Small change, Big Change

My people, how you doing? I went through some blogs and omo, the pre-vals tensions are high. hmmm, omo no too think, na the thinkin dey make the Naijablokes of this world promise to marry 20 girls for blogsville....LOL
How na? Na one of my pale ask about naija stuff na im make i go down memory lane. But eyin people, do you know we are blessed? Forget the 'westernization' we've had for the last half century and look at Africa as it was...
Na we build pyramid for egypt without caterpillar,
na we dey communicate with drums aka Gangan ...
Na we first invent high speed flyin aka 'ofe'
Na we dey cure anything with leaves and trees,
na we dey make our jewelry wey person no fit allergic to,
Na we dey make CORRECT soup without maggi and all the carbonate sulphates.
Na we go chop beleful and no go fat the kin yeye fat wey dey disgrace our people these days. We no need to chop leaf like goat to get nutrition and vitamins.
Omo, when did everything change??? Its so bad these days that i jam some naija babe wey dey brag that since them born am, she never chop 'African food'. I laugh, i tell am say na small pikin still dey worry am.

What brought all this up? Hmm, i dey yarn about intonations in our languages, na im i just dey wonder say wetin go happen if our forefathers continue with their 'OFE', no Visa be that..LOL, i go fit go blow Naijabloke for all his blogville affairs LOL. No i'm laughing but its paining me, you mean to tell me we no get 100% Nigerian product or 100% African product that the world has changed their lives to fit????. No talk plating hair, no talk food...wetin we don make the world change towards, afterall, 90% of our lifestyle these days is imported. We changed our dress sense, we changed our eating culture, we changed our work culture, wetin we don make them change????
I dont see Europeans wearing danshiki to work, I no see dem dey wak amala and edikaikan for restaurant, I no see dem dey wear beads or animal skin slippers...
So for a little ease, we traded so much? Eyin peeps... hmmmmmmmmmmmmmmmmmm

3 Comments:

Blogger 4wardnfiaca said...

madam,
na condition make crayfish bend o. na so so to belong our ppl dey try belong come begin give mo dan dem reciv.


oh, and lest I 4get, 4 d 1st time, i'm 1st...lol

10:28 PM  
Blogger temmy tayo said...

So I was beaten to 2nd position. Not so bad.

I dey trip jare for the fact that you fit chop the whole pot in Naija and not add weight.

12:33 PM  
Blogger Teva said...

@4wardnfiaca This crayfish don bend so tey e don turn to crab. We need to think about it....Congrats on being first

@temmy Yes o!, better food without 'calories'...LOL

10:55 PM  

Post a Comment

<< Home